This woman beg me eeh, she beg sotee, she kneel down, I no gree. I kon dey regret why I come do this send off knackis, she no dey even reason her daughter wey don catch us, how she go use beg her, make her other pikin no join for the matter, she busy dey beg for gbola.

No single sleep enter our eyes, the vigil strong. My chest just dey do gbim gbim. Immediately 5 knack, I use whisper tell am to open the door make I comot …

Mama Uka; haba! By this time? No na, e too early, what if something happen to you for road, wetin I go tell your mama? Wait make 6 knack, at least, before you comot”

Matthew; nothing dey happen. Na okada horn I dey hear so for outside, cars don dey pass. This na lagos na, our hood no dey sleep, you sef know that one. My uncle dey show for our house by 6, I suppose don dey there before then”

Mama Uka; no o, I no fit let you comot here by this time, day never break”

Matthew; no be say I no sabi open this door, na you I just dey respect. E better make you open this door now, make we start this wahala with your pikin on time, before day go break wella and everybody go dey hear and see wetin dey happen. I dey suspect say e go loud”

Mama Uka; reduce your voice na, which kain wahala be this? Na my pikin she be, she no go disgrace me. No worry yourself, I go handle am…

By then, I don dey lose my patience…

Matthew; Mama Uka, open the door, abeg. No be say we go dey inside this room forever, you go still open am, you no get choice”

Mama Uka; e don reach like that? Na me you dey follow talk like that? You this gůtter pikin”…

As she talk that one, the kain vex wey full my body. I know say I be poor boy, but I no be gůtter. If I be wetin she call me, how come I dey inside her room now? I dey neat, I dey baf well, I be fine boy, gbola large, na say I come from poor background. I no go tolerate this kain insult from this woman o, now wey e be say my levels don change. Na so I use vex waka go open the door.

Immediately Uka sight me, she rush me with better igbati, the thing land taaaaaar for my face. Her mama rush to hold her, but she don already jack me for shirt, say I no dey go anywhere…

Uka; so na you this boy dey inside my mama room? Woman wey get your mate for house, person wey senior your mama, you get mind dey gbensh am because of money. You don enter today, if you comot from here eeh, know say my name no be Ukamaka. All the neighbors go hear wetin you and my mama dey do, if I finish, I go carry my legs go meet your mama, make I tell am the kain person wey im pikin be”…

Na so Mama Uka kneel down dey beg her to free me, make I dey go, make the thing no reach outside, but she no gree. I dey struggle to comot her hand from my shirt, she see say I go easily push her comot, she kon dey shout her brother name, make that one kon help her. That boy wey no kuku like me from day one, dey send me message like say I be im house boy, when I dey work for their mama restaurant. Person wey I senior with one year.

Small time, the boy come out, sleep still dey im eyes, but e clear sharp sharp, immediately Uka yarn am wetin dey ground. He rush me ozugbo, begin gbege me o, Uka kon release me for shirt. Na so me sef enter the boy, I no go stand make my fellow boy dey wunjure me, no be say I tif. By that time, Mama Uka don open the front door, so that I go see road jakpa, but the boy block me, we dey struggle. I notice say na all these boys wey no strong, wey dey use friends make mouth. E no tey, I bring am down, he kon dey say make im no use eyes see me for hood again, say im boys go show me pepper.

I don see small space to jakpa, but Uka rush go carry one big stick, say if I near the door, she go land me the kpacko for head. I dey hold the brother for ground, make im no get up, but my eyes dey where Uka dey, if that stick land my head, I fit kpai or even faint. Mama Uka don shout tire, kon sidon for ground, dey cry. By the time she see say her brother na heavy olee, she wan near me with the stick, I dodge am, the thing land for her brother shoulder, that one kon shout eeh. Na so I stand up to jakpa, but Uka still find way to grab my shirt for back, dey shout…

Uka; where you think say you dey go? If na you catch my brother dey lamba your mama, how you go feel?”…

Omo, me wey no dey like toůch girls, I never try am for my life. I no know when I turn, sama am heavy igbati for face. My mama no be her mama at all, the woman dey fear God. No be my fault say her mama dey follow small b?ys wey she fit born, make nobody mention my mama for this matter…

The thing sef shock am, shock Mama Uka join, I see her face, as she put hand for mouth, open eyes wella, dey look me. Uka recover fast, kon still grab my shirt again. Her brother don manage get up, go inside, I no know wetin im wan go bring, but I no wan waste time to know. I tear the shirt by myself, free am for Uka, borrow Chioma Ajunwa sharperly. When I reach the gate, I see say e dey locked, I look back, the boy don rush out with kńife, na so I climb the gate, I no even think am two times. One leg of my shoes hang for the gate, but I no mind, I carry only one leg dey run dey go.

The first okada wey I try to stop, no gree stop for me. As I dey like wetin person no know. I no wear shirt, my trouser dey pull comot for my waist, na only one leg of shoe I wear. I stop to breathe small, kon feel my pocket, to make sure say my iphone still dey, the time na 6 o clock already. I kon remove the remaining shoe, throw way am for corner, begin leg am for street, dey go house, people just dey look me anyhow.

Luckily for me, I see one okada wey be my friend, na him kon carry me reach house. I lie give am say na some boys waylay me. Na the same thing I don reason to tell my mama and brother when I reach house. When the okada drop me, I tell am say I go pay am later. Before I enter house, I call Peppe driver to find out where im dey, he say he go dey my house in 30 minutes time. As sharp guy wey I be, I don code say Mama Uka children go definitely wan come my house ozugbo, to tell my mama wetin happen, na so I tell the driver make im meet us for one junction like that, say landlord come early mormor to pursue us comot for house.

Na to rush inside go hurry my mama and brother, I no go allow them baf sef. Thank God say I tell them to pack our bags yesterday night…

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *