Omo, e get when e reach eeh, Mama Uka no fit control herself again, her scream kon dey reach the next street, me sef tire to warn am to take am easy, I kon kukuma free her. She no dey worry about her children, shey na me go kon dey worry? The woman too loud, abeg. I dey wonder if na like so she take do, take born her 3 children. Only God know how dem take cope sha. I know say my gbola finish work, every body dey confirm am, but dem still get control, this one just dey shout like say she never taste sweet thing for her life before. As the ring tone enter gear 5, she kon dey stammer, dey mention my name …

Mama Uka; Matthew o, matthe, matt, maaaaaaa, abeg na, abeg, you go kpai me o. Ewu chim o, ogunu? Matthew, swear say you no go leave me, swear say you no go, you no go, you no… ewu chim ooo. This boy, iga egbukwanum ooo. No leave me, abeg na. I know say I no too get money, but I go take care of you. My chest fit break if you comot this sugar for my mouth. See me, look me for faaaaaace… ewu chim ooo… chineke meeee. Look me eye ball and tell me say you no go comot this sugar for my mou, mouu, mouth… nna eeeh, wetin be this sugar na? This one sweet me pass others o. The sugar dey make me be like I no dey breathe well again”

Matthew; shey make I stop, so you go rest small?”

Mama Uka; stop fire. Dey dig am dey go, na you get am. Una no dey two wey dey share am. Say I dey vibrate like this no mean say I wan make you stop o. Dig something dey go, just dey go like that, no stop, dey go like that. You dey get am exactly how I take see am for dream. All the koro wey you dey dig go, plus the one wey you take mouth arrange, na so I take dream am yesterdayyyyy… ewu chim o. Nna, you no, you no wan, you no wan answer my…”

Na so heavy banging for the door, shut am up ozugbo. E don red, e good like that, make all man rest, since she no dey hear word, dey shout like small pikin. Oya, e don happen, dem don dey knock for us. I cool down comot my gbola from the kpomo, use eyes locate my clothes, incase I need dive. No be me person go catch like this, mbanu. Even if dem wan catch us, I must wear clothes. The banging for the door just dey increase, Mama Uka give me sign make I no talk. I try to wear my clothes, she still give me another sign make I never wear my clothes, I no even send am, if I hear. Maybe she dey hope say if we no make any other sound, the person go stop to dey knock. Upeeeh! The knocking no be like wetin wan stop. The next thing, na Uka voice I hear.

That one voice wey I fit recognize for my dream. The girl too set, e don tey wey I dey eye her, but she no dey look my side, I no get shishi na. She laugh me wella the day wey I beg her for her phone number, she laugh me finish, waka comot. Na her mama kon carry me almost wholesale, until sweet mango Peppe take over. I wonder how she go feel, if she discover say I dey laba her mama.

By the time I don wear my clothes finish, Mama Uka sef don kak up, she kon say …

Mama Uka; na who be that wey wan break my door for this o clock? You no know wetin be time? Na 2 o clock dey waka pass so”

Uka; oh, so you know say na wetin time dey talk, but you dey shout like person wey dem wan kpai? I no know when you go stop this kain life. Shey na only you dey do knackis? If you no go respect yourself, at least, respect us wey be your children. Na me supposed dey carry man come house, dey behave like this, no be you”

Mama Uka; na who you dey follow talk like that? Make you no forget say na your mama I be o”

Uka; behave like my mama na. If you want respect, you no go dey behave like this. You dey shout, as if you no know say we dey hear your voice, even the neighbors sef dey hear am. Na every time wey you dey do knackis inside that your room, the whole street go know say you don carry man come house again” …

By that time, my gbola wey been stand, don finally come down finish, I just sidon for one corner, dey press my phone, but my ears dey wetin dem dey talk. Wey I for stay with my mama and brother, dey plan how we go take move go lekki in the morning, kai…

Mama Uka; I no know wetin I go tell you this night, but no worry, na in the morning I go face you, I dey pray now, you no fit distract me with your insúlt”

Uka; pray fire, akuko. I don first go lock the back door from here, you and that man no go fit comot from that room, except una pass here. I go sidon for your door till morning, make I use my 2 korokoro eyes see that prayer wey you say I dey disturb. I dey here dey wait for you, since you say we no go sleep, make we kukuma do vigil. Other people mama and children dey sleep now, but my mama carry man come house, dey shout up and down, dey embarrass us, to make sure we no sleep”

Mama Uka; if I open this door, catch you for there eeh, you no go like wetin I go do you o. You go tell me whether na you dey pay for this house or na me”

Uka; open the door na, I dey here. Na only talk you dey talk, you know say I go see man inside, na true I dey talk, na why you no wan open the door”…

Mama Uka no talk again. I just dey look am one kain eyes, that eyes wey dem dey look person wey don cast. I warn this woman o, I warn am wella, make she calm down. See something wey I wan use do sendoff for am, do am reach 3 times atleast, before morning reach. Na first stage we still dey, this kasala burst like this. I don try my best, thank God say I dey comot from this hood tomorrow, how I for take face this shame? Na wa o.

The next thing wey this woman do, shock me sha. She waka quietly, kon touch me, whisper to me, say make we continue wetin we dey do …

Mama Uka; this werey pikin wey I born, no go stain my white o, we must finish wetin we start”

Matthew; omo, e go hard o, my gbola no dey rise for duress. As I dey here so, I dey fear embarrassment and gossip”…

I whisper give am back…

Mama Uka; no na, nothing dey happen, na me dey tell you so. My body still charge, e never cooleeee, abeg, make we finish this thing, I no go shout again”

Matthew; so you sabi say na your shout cause this wahala? Now, you want make we continue, say you no go shout again, something wey I don dey tell you since we start”

Mama Uka; no blame me na, na you cause am, the sugar no gree me control”…

I been wan use vex tell am say na lie, no be my sugar anything. The way her pikin dey talk, be like na wetin dey happen on a normal, she just dey use my gbola deceive me. I sha calm down, make I no go tell am the one wey go pain am pass the one wey her pikin don already tell her finish…

Mama Uka; come back for bed, I promise, I no go shout again, e no possible. I go make your gbola stand, make we for finish the work, abeg. E dey my body, bikonu, nna”

Matthew; na me go now shout if we try am again. I gats shout wella, before the thing go answer me, na inside duress we dey like this, e no go possible, my shout sef, fit make your neighbors come join to knock for you. Make we calm down, find how we go take comot from this gbege, your pikin dey your door, she don lock the side wey you take sneak me in, how we wan use comot from here? I need leave here by 6, early mormor, sharp” …

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *