As I enter house, my mama and my brother don already dey wait for me. Dem don baf finish, our bags wey dem pack, dey for corner. Immediately my mama see me, she shout…
My mama; abobo nwam, ogunu? Wetin happen to you? Wey your shirt and shoes? See as your jeans dirty, wetin happen o?
Matthew; na some hood boys gba me for road, as I dey come back. Dem collect my shirt and my shoes, as dem wan collect my phone, na so I jakpa, na why dust full my legs so, my trousers kon dirty”
My mama; chai, na wa o. Thank God say nothing happen to you. Which mouth I wan use talk am? Say my pikin wey God don use change my life don kpai, God forbid. Dem wound you for face join o, sidon, make I find something take clean am for you, before you go baf”
Matthew; no need, e no dey pain me, na just small cut. Driver go soon reach, he say make we wait am for bus stop, the car no go fit enter here again, you know say our road no good, the car almost spoil the last time. Make I quickly wash my legs and face, den wear my shirt and shoes, make we enter road, no time”…
I no even let her talk again, I rush out to wash my legs. My body no relax, wetin Uka tell me just dey ring for my ears. If she and her brother come here, e don be for me. Nothing go ever make my mama agree to follow me go Lekki again. How I wan take face her, if she hear say na women wey senior her I dey do knackis with, for money?
The speed wey I take rush myself, I no even check the house well, to know if she pack my things finish, I just carry my iphone pack wey dey corner, with my charger, put inside my bag, we begin move. Na my brother lock the door. I carry my mama bag for one hand, carry my own bag for the other hand, na so I begin hurry my mama. She sef no behave like herself normally, she just dey waka fast, dey follow me for back. I see one okada wey just drop person for opposite our house, I kon tell am to carry my mama and our bags, to junction, make me and my brother