After Peppe go, I enter house, make I use better shower baf, for better bathroom, for the first time since my mama born me. I almost burn myself with hot water, as I no sabi handle anything inside the bathroom. After small time, I code how to run am, na so I shower all the stress wey I experience that day, my body cool down wella.
When I baf finish, I dress up, say make I go check up on my mama and brother, dem still dey shock about the house and everything wey dey happen, my mama dey inside kitchen, dey look round, I no disturb am. My brother dey his room, dey look like person wey no know where to start from…
Matthew; bro, how far na? This one wey you sidon like person wey confuse”
My brother; guyyyyyyy! My head dey turn like this, I no even know where to start from. Yesterday, I dey live for batcher, today, I dey live for this kain fine house, just like that”
Matthew; yes, I get how e dey do you for body, na so e take do me sef, the first time wey I come here. No worry, you go dey used to am, after a few weeks, na our crib be this now, no more batcher”
My brother; chai, this life eeh, God dey o. Make you no feel like say I no appreciate everything wey you go through, to make sure say we dey comfortable, my head dey there. I see the sacrifices, I see am, bro. Thank you”
Matthew; no issue. Make I go crash small, the kain sleep wey hold me now, I no fit explain am”
My brother; go sleep, jare, you deserve am. If say AC no dey this house, I for say make I come fan you as you dey sleep. Ehen! Before you go eeh, shey my babe fit dey find me come here, abi?”
Matthew; yes na, she fit dey show, you no get wahala”
My brother; as e be say I don get my own room now, she fit dey crash once, once na? You know how the matter take be”
Matthew; omo, no be me be the problem, na maale you go dey reason. You know say me no dey send all those ones. Make you sha dey careful, make you no give girl belle, this one wey you say you wan go school, you still be small boy o”
My brother; no be today na, I know how e be for streets, I no fit let my babe go through that kain thing, I dey protect her wella”…
I finish with my brother, kon go my bedroom, as latest big boy wey I be, na masters be my bedroom, everywhere and everything big like my gbola. Na so I knack myself for the bed, say make I rest small, before Peppe go call me for service. E no reach 2 minutes, my phone begin ring, I no know the number wey dey call me, as I pick am, na Mama Uka voice I hear…
Mama Uka; Matthew, how you dey? Follow me talk na, abeg, just tell me say you dey okay, na the only thing wey I wan hear be that”
Matthew; no worry yourself, I dey very okay. I go suggest make you no call me again, abeg, I no want wahala. Wetin my eyes see today, I never see am before for my life”
Mama Uka; chai, nna, no dey talk like that, you wan kpai me? Wetin you want make I do?”
Matthew; I wan sleep now, all my body dey pain me”
Mama Uka; I go leave you make you sleep. Shey we go fit see tomorrow?”
Matthew; God forbid, I no sure say I go ever use my two eyes see you again, I no fit try am”
Mama Uka; so you go get mind treat me like this, after everything wey I do for you for this life? Say you dey use good phone, na because of me, say you get good clothes and shoes today, na me. Just this small challenge wey you face from my children, you wan abandon me, that one no go happen o”
Matthew; yinmu! As if na free you take buy me phone and clothes, something wey I use my gbola pay for. When e dey sweet you, noise full your mouth, because I dey too sugary, you no know say na the things wey you give me I dey pay for? Like this sef, na you dey owe me, I service you pass wetin I get from you. If say your children kpai me, you go get mouth dey call am small challenges. Abegy, comot from my phone, make I sleep”…
Before she go talk again, I switch off the phone, throw am for one corner, kon doze off. By the time wey hunger wake me, everywhere don dark, I kon turn on my phone to check time, midnight don reach. Nothing don dey for the house, na by morning, I go find way to stock up the kitchen, make my mama begin cook. I wonder wetin dem eat. Everywhere just quiet and dark, I waka enter kitchen, e get small food wey dem eat remain, na fast food. I sure say na my brother buy am, as I dey sleep. Na so I rush the food, ozugbo, when I finish, I open fridge, see another food wey dey inside, maybe na the one wey he buy for me. I rush that one again, begin eat cold food, as hunger no be my mate. Microwave dey the kitchen, but I no sabi operate am, I go reason Peppe to send person wey go come teach me how to use the things wey dey the house.
E never tey wey I start to eat the cold food, many text messages just dey enter my phone. Na Peppe dey para for me, she really change am for me sha, she think say I off my phone to dodge my gbola duties wey she tell me, before she go. I quickly call am…
Matthew; hello, ma”
Peppe; wetin dey worry you? Na wetin we talk be this? Relationship never start, you don dey misbehave. I no get power for sugar boy wey dey do anyhow o”
Matthew; no be so, ma. My body weak wella, I say make I rest small, I no know when sleep carry me go”
Peppe; shey na why your phone off?”
Matthew; no ooo. Na low battery ???? I don charge am now, no vex, abeg”
Peppe; Rule 1, I no wan call you for phone, make your phone off or make you no pick up. If you miss my call, make e no take you up to one hour to call me back, if you wan sleep, you go text or call me to tell me say you wan sleep. You no get any other work wey you dey do, na me be your work like this. You dey hear me so?”
Matthew; yes, ma”
Peppe; yes, Peppe!”
Matthew; Yes, Peppe”
Peppe; wetin you dey do now?
Matthew; nothing o, I just eat finish, I wan go back to bed”
Peppe; which bed? Who go chop this my kpomo wey don dey breathe since morning? Dress up, jare, driver go come pick you now”
Matthew; e no go good make we run am in the morning? E don late o, na almost 2 for midnight”
Peppe; I no want am in the morning, na now I want am. If I no feed my kpomo now, I no go fit sleep. Oya, dress up, driver dey road”…
Na so I just weak. This work no go easy o, no rest for this gbola. How my mama go feel, if she wake up tomorrow, inside this new house, she no go see me? Wahala…