By the time I finish with Peppe, her body just dey shake, even her voice join. She been wan tell me something, but words no gree come out, she dey try catch her breath. I no even know when I doze off, man pikin don exhaust completely. Na as I dey sleep, Mama Uka call me for phone, Peppe tap me for shoulder make I wake up to pick the call. She signal me to put am for speaker, as she know who dey call. Wahala …

Mama Uka; nna, you still dey vex for me? I say make I give you small hours take call back, maybe your vex go don cool down”

The next thing, Peppe put mouth inside the call wey no concern am. I been think say she no want make Mama Uka know say she don kolobi me o, this woman get mouth sha. Anyways, she get money pass Mama Uka, na person wey get money pass, dey get plenty liver…

Peppe; bia this woman, shebi you no go leave this small boy alone, abi? I no wan put my mouth before, but your own don too much. Aah aah! Wetin sef? Na so you go dey call am when we dey busy, even by this time. Abeg, go find another smally, I don take over this one”

Mama Uka; wait, wait, wait. Osanobua! Shey my ears dey pain me abi which person voice I dey hear so?”

Peppe; your ears no dey pain you, Nkolika. Na Peppe voice you dey hear. Leave Matthew alone, I don give am my mark already, na me get am now”

Mama Uka; you this woman, na so you dey do? So na the reason wey make you tell am to help you carry something go car be this? Only once wey you see my boy, you don run hustle am. Something wey no be your own, something wey I no fit do to you. I think say we be friends”

Peppe; wetin do our friendship before? We still be friends o, unless you no want again, if you go let small boy preeeeek come between our friendship of 15 years, na you sabi”

Mama Uka; Matthew, so na the Lekki wey your uncle dey live be this?”

Peppe; no dey talk to am, talk to me, woman to woman. This boy no go follow you talk again, after now, I go personally block your number comot from him phone, since he no wan do wetin I tell am. See me see wahala o, person wey just chop me finish, make we rest body wella, so we go see energy take run another one, before day break, but you no gree. You go just dey call am anyhow, dey disturb us”

Mama Uka; Patience, e no gň better for you o. This thing wey you do me so, another person go do am to you, just watch and see. I dey cry for you and my tears no fit go like that. Boy wey I bring out from the gutter, clean am up, naim you clear eyes collect from me, for broad day light. You go see”

Peppe; akuko. You dey tell a multi billionaire like me say e no go better for me. You no dey shame o, na small pikin gbola you dey cry for, pikin wey you fit born keep for house. Hehehe ???? This food vendor sef, shey you dey whine me? Na you go loose-guard na, you know say you no get money, you dey flaunt gbola wey you suppose protect, person wey get money pass you don collect am from you na, you dey yarn okpata, sha no come late for our next meeting. Oya, make I block you, make my sugar rest for now, work plenty ahead”…

As she talk finish, she end the call, kon give me to open the phone and give her back. She dey my front block Mama Uka phone number…

Peppe; e be like your ears na for fancy, abi? Shebi na person wey I tell you to block be this so? No let me vex for you o, e dey too early. I no want anything wey go make me and you quarrel. If I tell you to do something, make you do am sharpely. You hear me so?”

Matthew; yes, I hear you. E no go happen again”

Peppe; I know say e no go happen again, unless you wan see the other side of me wey you no go like. She get another number wey she dey take call you?”

Matthew; no other one”

Peppe; she still fit try your line with another number, I know that woman, she no dey quick give up. If you hear her voice, make you block her one time. Ehen, wetin she dey beg you to forgive am for?”

Matthew; oh, okay. She think say e get wetin she do me wey make me dey avoid am”…

The good thing about Peppe be say she dey notice when I dey weak, na she tell me to drink water and sleep, she see as I dey weak. If na Mama Uka, that one go wan milk me dry, she no send.

One year later…

I don balance wella for the new house, my mama don dey sell foodstuff for Ajah market, she dey happy, dey do well. My brother dey process his admission wey Peppe agree to pay the school fees for university. I don sabi cruise the ride wella, money bam for my account, life don soft. Na every 2 days I dey gbensh Peppe, na the arrangement be that. I don even follow am enter Uk once, the 5 years visa wey dem give me, still dey breathe for my passport like this, we don go ghana, South Africa and Yankee. Life just dey sweet, e no be like say anything fit spoil am. I no dey even see other girls at all, dem no reach my Peppe anywhere.

One day, I dey Peppe secret house, our usual meeting point, dey wait for am. I been don call am for phone, say I don reach, she say make I wait, traffic hold am. I dey for balcony, dey sip orange juice, na so one Angel just enter the compound. This girl fine eeh, I never see her before, I no know who she be or who she dey find. I try to remove my eyes and my mind from the erinma, but I no fit. Her long legs and beautiful face just gum my eyes, she be like chocolate. I just dey watch, as she dey follow gateman talk, ideas full my head, my gbola don stiff, e dey respond to stimulus. I no remember Peppe that moment, na the Angel my mind dey…

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *