I wait for her to finish with the gateman, luckily for me, na she carry herself waka come meet me where I dey for balcony, to greet me. By the time she reach me, my palm don dey sweat, heat gather for my forehead, ozugbo. Una remember say my gbola still dey misbehave, e never calm down. I quickly sidon for chair, make she no notice am, I no wan lose this babe, na God carry am come near me like this. No be say I no dey see other girls since I dey with Peppe, na say dem no dey move me at all, na only this particular one don move me like this, na wetin make me know say na serious sign be this, I gatz shoot my shot wella…
She talk; Oga, good evening. My name na Omayioza, I come from Ebira, Kogi state. Na work I dey find, I dey go house to house, to know if anybody want house girl. Na the gateman say make I come meet you, to know if una go like employ me. He say cleaner already dey here, but I sabi do other things, like cook, wash clothes, any type of house work like this, I sabi”…
I never still talk, the greeting sef wey she give me, I no answer. Shock still hold me, this babe wey I think say relate to Peppe na house girl work she dey find, omo, see jackpot sha. How fine babe like this, wey set, tall, with smooth skin, chest and nyash dey right size, wan do house girl for person? No correct bobo don see this girl kolobi am. Na wa o, people no get better eyes o…
Omayioza; Oga, no vex say I dey disturb you, abeg. You no talk anything for wetin I tell you, if e get as you go take help me to get this work, I go dey grateful, I really need am, abeg”…
I catch myself…
Matthew; e don do. I get small questions for you first, make I take know how I go take help you, where I wan start from”
Omayioza; no problem, sir. I go answer your questions”
Matthew; how many years you dey, why you dey find housegirl work, your papa and mama nko? Fine girl like you”
Omayioza; I dey 20 years, my mama don kpai when I small, na only my papa dey for us now, him dey do bricklayer work. Na me be first born, I get 2 younger ones, dem sef dey do house girl work”
Matthew; eeyaah, sorry say your maale don kpai. You don do this kain work before, abi na your first time be this?”
Omayioza; I don do am plenty years, since I dey 12 years, I don dey do housegirl. Wetin make me comot for the last place be say my madam begin vex for me, say oga dey like buy me things, she kon dey bčat me any how. Any small thing wey I do, she go dey shout for me, na wetin make I quit”
Matthew; so your oga dey chow you? Talk true o”
Omayioza; no o, God forbid, sir. The man no try am o, na better person he be, I dey work well for the house, dey take care of their children, so anytime he buy things for their children, he go buy for me sef, say I dey try”
Matthew; No problem. Abeg eeh, no dey call me sir, me and you dey almost the same age. Na this year I just make 22 years, I never reach Oga wey you dey call me, you hear?”
Omayioza; okay”
Matthew; I no sure say my madam go employ you, infact, she no go gree. Na elderly people she dey like to give house girl work, and na mostly professionals for company she dey hire. The cook wey dey work for this house no be small pikin, even the person wey dey take care of this house so, the woman reach to born 2 of us pass. You know wetin go happen eeh? My maale need househelp, work no too dey the house. Na only me and my younger brother, dey live with am”
She wan kneel down to thank me, na so I carry the opportunity take touch am for body. E soft děe, see as God take butter my bread, I don get correct babe like this, na this one go be the first babe wey I go buy phone for, iphone for that matter. The babe too set, abeg. My hands touch am wella, as I try to make sure say her knees no reach ground to thank me”
Omayioza; God bless you, I really appreciate. You no go regret this thing wey you wan do for me so, your mama go like me, as I sabi work wella”
Matthew; no problem. When you go like start work and how much be salary wey you dey collect?”
Omayioza; the place wey I work before, na 2Okpa dem dey pay me per month. I go like start tomorrow, if e dey okay with you”
Matthew; no worry, if you do well, I go pay you pass 2Okpa. Put my number for your phone, send me WhatsApp message, make I give you my address. I go yarn my mama about you today, so we go dey expect you tomorrow morning”…
She bring out one kpala infinix phone wey she put for the pocket of her skirt, I give am my number, I kon hurry am to dey go, I no go like make Peppe see am for this house, that one too dey suspect any small movement.
The way I chow Peppe that night eeh, she sef dey wonder wetin take over me, body just dey sweet her, she dey ask if I don begin watch mňjo again, wey make me know new styles, she no know say na Omayioza wey I carry for mind make me dey ginger, I dey gbensh Peppe, dey imagine say na Omayioza I dey do.
The next day.
She land our house, with her small Ghana must gň bag. The girl na really poor babe o, she just remind me how we been dey live for batcher. She don meet her destiny helper like this, destiny helper with correct gbola. I don already yarn my maale wetin dey sup, that one no get wahala, she kukuma dey find person wey go dey keep am company, dey follow am watch Nigerian movies, as me and my brother no get time for those kain things. My maale welcome her wella, carry am go show am room wey she go dey stay.
When she finish with my mama, I call am enter my room for the final interview…
Matthew; you don see say my maale no get wahala?”
Omayioza; yes, I see am. Thank you for this opportunity, you no go regret am”
Matthew; I know say I no go regret am. I go dey call you Oma, your name dey hard me to pronounce”
Omayioza; no problem, na wetin some people dey call me”
Matthew; wetin the name mean?”
Omayioza; e mean say dem born me for Humanity”
Matthew; that means you go be better person o. You get boyfriend?
Omayioza; no, I no get. Na before I get, but me and the boy don break up, I no dey get time to see am, my former madam no gree give me off days”
Matthew; okay, no problem. Anybody wey ask who you be, you go say we be cousins, say you be my papa brother pikin. I no dey like call anybody house girl, e dey heavy me for mouth. No ever make mistake tell another person outside this house, say you be house girl, you dey hear me so?”
Omayioza; yes, e no go happen”
Fast forward to 1 month, me and Oma don dey date, but I never chow am, I dey slowly penetratč am wella, make she no reason say na only chow I carry for mind. I tell am say Peppe na my madam, I dey do work for am, she believe me, but dem never see themselves before. Peppe no dey too come house, because of my mama.
Na the night wey I finally decide to chow am for the first time, kasala burst ????, Peppe come house…