After that incident wey Peppe almost catch us, I kon begin dey extra careful. Anytime wey I wan do knackěs with Oma, we go run am during the day, my maale no dey suspect anything, that one kukuma believe me kpai. She even say she like the way I dey treat the girl, say I dey do her like say she be my sister, she no know say I don chow the babe, left, right and centre. Her kpomo wey dey too těght, I finally find way to enter, I buy one water cream like that, wey be say if you apply am for gbola, no matter the size, e fit enter tear rubber kpomo.
Na cap I start from, dey push am dey go, until one day, everything enter finish. Since then, the thing dey swallow am, without mercy. E still těght o, but e no dey pain Oma again, or even wňund me. Whenever I dey land Peppe, na Oma I dey reason, e kon be like say I don fall in love with the babe sha. I later buy her better phone, though, no be iphone, as she say na Samsung she like pass. I even change her wardrobe, then she carry me go visit her papa, poverty make the man look old pass im age, I dash am better mula. He thank me finish, kon begin beg me not to give im pikin belle, say he no go fit bear am, dem don suffer too much. I give am better assurance say that one no fit happen, say I take Oma like my sister, I no dey touch am, but the way he look me, I know say im no believe am.
Life just dey sweet me dey go, no wahala at all, e just be like say I dey paradise. I even follow Peppe enter Yankee again, we stay one week for there. My own na to sidon for hotel room, order anything wey I like, she dey even send oyibo people come room sef, to massŕge me, for each trip wey we go, while she go comot, to go handle the business wey carry her come the country, later, she go carry me go shopping, for night, she go collect fresh gbola from me. The trips dey sweet me, but e dey somehow stressful, because, na every night she dey collect, as we dey together for same room, unlike when we dey naija, where e no dey happen everyday.
By the time wey we land, normally, she dey put me inside cab wey go carry me reach house, I no know wetin enter her that day, wey make am say she go drop me for house, I no too reason am sha, until we reach house. I been wan come down for gate, but she say no, say driver go drive in, make she hail my mama, say e don tey. Omo, na Oma open the gate for us, I weak as Peppe see her, the kain frown wey she carry look me. When we drive in, she tell driver to comot from the car, say she wan follow me talk, as driver comot…
Peppe; who be this girl? And no tell me say na your brother babe, because I don see him babe many times for here” …
As if she know say na wetin I been wan talk before, na my brother I wan use cover up, but e don late, na to stick to the original plan, sure pass like this. Oma dey by the side of the house, dey wait to see the person wey dey inside the car, na tinted glass dey back seat, she no see Peppe and me…
Matthew; no o, no be my brother babe, she be my cousin, my mama sister pikin, she come visit”
Peppe; just like you tell my friend, Mama Uka, say na your Uncle you dey visit for Lekki, abi? Hope no be your babe be this? I go ask your mama o, that one no kukuma sabi lie”
Matthew; haba, Peppe, why you dey yarn like this? Fear no dey catch me to carry babe come this house wey na you get? No na, you fit ask my mama. We don dey together for long now, this one show say you no trust me, and e pain me, upon everything wey I don do to earn your trust, I never touch any babe since I meet you”…
My chest just dey sound fast, if she ask my maale, the whole thing go cast, ozugbo. Maale go tell am say Oma na our maid, when I don already say na my cousin, abi I for kukuma talk true say na maid?…
Peppe; make we come down, I don tire, I need give your mama the things wey I buy for am, so I go rush go house, go rest”…
As we come down, Oma rush me to greet me with hug, come carry my bag, she almost kneel down to greet Peppe, she kukuma get better respect. But Oma fine sha, the babe go produce fine children, her face dey give joy. Peppe look am from head to toe, kon turn look me, I just dey pray for my head. I no expect am to follow Oma talk, e shock me …
Peppe; fine girl, wetin be your name?”
Oma; my name na Ada, ma”
Peppe; oh, na you be Matthew babe, abi?”
Oma; na my brother be this o, my cousin, this one no fit be my boyfriend, na abomination”
Peppe; how long you don dey here?”
Oma; e don dey go one year now, I say make I come dey stay with my aunty, as she dey always complain of loneliness for this house”…
Na so Peppe look me again, shock dey her face…
Peppe; almost one year, Matthew. Why you no tell me say una get visitor? This fine girl dey live for this house, all the time wey I dey visit, I never see am, and you no even mention am to me”
Matthew; I no too reason am na, I no know say I suppose tell you, no vex, abeg”
Peppe; no wahala, go call your mama for me, I dey in a hurry, I no dey go inside”…
I waka go inside, Oma follow me for back, as we reach, I enter inside my room, then tell her to go call my mama for Peppe. This Oma na sharp babe sha, see how she quickly change her name to Igbo, make e balance well say she be my cousin, she good, abeg, omo.
My window face outside, I from there dey peep Peppe, as she stand dey wait. E no tey, my mama come outside, with Oma. She and Peppe greet finish, Peppe kon give am wetin she buy for am, from Yankee, my mama just dey dance, dey praise am. Maale kon pause, look around, then ask about me, Peppe tell am say I don enter inside.
I no fit bear am again, I just sidon for ground, dey reason where to start from, if Peppe discover who Oma be, from my mama. The next thing, my phone ring, na Peppe, I quickly stand to peep from window, Peppe don enter car, Oma dey open gate for am. I pick my call …
Peppe; I don dey go, we go see on Tuesday. I want make you send Ada out, I no wan see her here again. I believe say na your cousin she be, but I no too dey comfortable. People dey do knackěs with their cousins, no be new thing, anything fit happen”…
I first breath well, say the matter never really cast…
Matthew; shey babes don finish for outside, wey I go dey do knackěs with my cousin? No na, the thing sef dey sound somehow for my ear, abeg, comot mind from there, nothing fit happen, trust me”
Peppe; Matthew, I trust you, but na the girl I no trust, her mouth too sharp, make she dey go, abeg”
Matthew; how I wan take tell my mama this kain thing? She don already dey used to her, that woman dey very happy now, I use God take beg you”
Peppe; find wetin you go tell am, na one week I give you, if I come there again, see Ada, we go get serious problem. If na who go dey keep your mama company, I fit arrange person for am”
Matthew; Peppe, no do like this, abeg na”
Peppe; na this beg wey you dey beg me so, dey make me feel somehow for the whole matter. One week, na wetin I give you so. One week!…
Enjoy oh yeee gbola children’s ???? ????