My brain begin work fast, how I go take run this one now? I think am sote, I decide to talk to Oma, as e be so, na Peppe be bank, if matter cast, money no go show again, I go lose the house and Oma sef go follow feel am. No be say I no get money to rent better duplex, but I wan use the money wella. I don dey make plans to carry my mama and brother, enter yankee. The few times wey I don follow Peppe go there, my body cooleee, to show say na there I suppose base, with my family. I even mention am to Peppe one time, as joke, she say make I clean my mouth, say na she get me, and I no fit go anywhere, she talk am with vex, I quickly apologize, say na joke I dey o, make she no take am personal.
As Oma enter my room, we rush ourselves eeh, like people wey never do knackis for one year, e remain small sef, I for swallow im face, where I dey kěss am, we kon dey breathe like people wey dey chňke. Omo, return knŕckis dey sweet, no be small, e get the kain feeling wey dey inside, e different from the normal one wey we dey do almost every day. I notice something about Oma, when we begin do boyfriend and girlfriend newly, she dey form like say she been no too dey do knŕckis and she no really like am, but after we don do am like 3 times, when my gbóla don fit the kpomo wella, she kon show me her true color. The babe dey good for mmekwe, to position and shape the express for me to drive in, na small thing for am.
Abi na her face? That one na another thing, I no know how to explain am, for una to understand me. Only her face sef go make gbóla get more energy to dey pump dey go, she dey use face encourage me, and appreciate me at the same time. The girl na every man dream, she sabi cook, she no dey lazy, she get respect wella, she kon sabi mmekwe, if we last for this boyfriend and girlfriend thing wey we dey do, I fit marry am.
As we finish, we land for bčd, kon dey rest, na when I bring up the matter…
Matthew; Omalicham, you know say I love you, abi?”
Omayioza; yes, I know. Wetin you buy for me from obodo oyibo?”
Matthew; I buy better things for you, no worry, I go give you before we sleep, but e get important thing wey I wan follow you talk first”
Omayioza; wetin be that?”
Matthew; I go like make you go back to your house, I go come dey visit you there, and you sef go dey visit me here”…
As I talk am, she sidon well for bed, kon dey look me like say I don kolo…
Omayioza; which kain talk be this one na? Be like you wan whine me”
Matthew; no, nne, I no dey whine you, I dey feel like na the normal thing to do, all my friends wey get babe, dey miss their babes, dem dey visit each other, the love dey sweet, na wetin dey make am last, but as we dey see ourselves everyday like this, e fit tire us”
Omayioza; this one no be talk o, many girls dey live with their bobo, no be say we dey even stay same room, I get my room, you get your own, where this kain talk from come out? If you don tire for me, just tell me, make I just carry my bag dey go”
Matthew; kai, I wish say you go understand me. If you see the kain fear wey dey enter my body, any time you dey my room eeh, if my mama catch us, she no go dey happy with me at all. Say you get your own room no mean anything, na here you dey steady. I no get another person, na only you I get, you sef don see am. I no dey comot from this house, except when I go work for my madam, Peppe, and I dey come back straight. Abeg na, reason this matter wey I yarn you so”
Omayioza; what of my work? Shey I go find house girl work for another place, abi na wetin? I no fit stay idle, I need to dey make money, you don see my family na, we no get shishi”
Matthew; Eeh? God forbid bad thing, no talk am again, kai. You no fit do house girl for your life again o, except say no be me be your bobo. I go still dey pay you every month, and dey take care of you, but you go find where you go learn hand work, if na hairdresser or tailor work, even if na how to rub makeup for people, na wetin dey reign for girls now, if you learn am finish, I go open shop for you, na you go get am”…
As I talk that one eeh, she kon smile better smile…
Omayioza; you mean am? God, you go open shop for me, who I be? Na wetin you for talk since na, this one na better plan, who no wan get im own business? You don make me happy, but I go miss your mama o, that woman too nice, chai”
Matthew; no too reason am, nne, no be travel you dey travel, you know say you go dey come visit us any time wey you want, sometimes sef, you fit spend night join. You na family now, you be like younger sister wey I no get”
Omayioza; younger sister keh? Story, sister wey you dey knŕck”…
The talk really end well, no be as I take expect am, we use another two mmekwe take seal am. Na that moment I begin reason say time to open office for Peppe head, don reach. To start my life don dey hungry me, I no go gbensh persňn wife forever na, I gatz find wetin I go use my life do, this America wey I dey reason, I must carry my mama and brother go there and Peppe go run everything.
Na to find how to cook am now, we she no go suspect say na jakpa, I don tire, I no wan do again, I don fall in love with Oma…