After Omayioza move back to im papa house, I help them arrange the house small, as she begin complain of heat and mosquitoes. Na so e suppose be na, person wey don manage see small life for my house, wey light no dey ever off, if nepa take light, big generator dey standby. Na my babe she be, me sef no want make she suffer, make her fine skin wey I don clean up finish, to scatter again. I put better fan for them, that type wey be say if e dey blow like this eeh, all the clothes wey dey inside the house go fly comot outside, if you no close door. I settle their nepa bills, buy generator for them join. I no be that kain boy wey no fit take care of im babe, kpomo wey be say na me dey chop.

As for madam Peppe, I begin work am ozugbo, I no even waste time at all, the woman too smart, before you see am, she don see you, I say make I use street strats on am. The next time wey I bring up the matter say I wan carry my mama and brother go vacation for yankee, I talk am like person wey no dey happy at all, like say I wan cry, I no even service am well, make she for know say abobo no dey happy. She quick notice the mood, as sharp woman she be…

Peppe; my love, wetin happen to you today na? I no understand”

Matthew; nothing happen”

Peppe; you no go tell me that one, talk to me, wetin be the problem? Since wey you come here, you just dey carry face, gbola wey never disappoint me before, no kon do well today, you chop kpomo like bitter-leaf wey dem never wash. This thing wey you been dey drink like vanilla icecream, eeh, nna, talk to mama, you know say anything wey be the problem, I go handle am. If you no dey happy, wetin you want make my kpomo do kwanu?”

Matthew; e don tey wey I know you, I dey do everything wey you talk, I no dey follow girls or do anything to vex you, and I never beg you for something before, but only one thing wey I beg you, na so you change am for me, like say na abomination I talk for mouth”

Peppe; haba! Me, Patience, change am for you, when that one happen na? As I dey pet you so, dey treat you like egg, because of say I love you pass anything”

Matthew; me sef love you, but I no want make e come be say I dey fear you, I no suppose dey fear you at all, na respect I suppose dey give you, na this my family size gbola dey make you dey alright o, and I dey deliver wella, dey give you better joy inside your heart. You don ever see me go wash my mouth or throway spit after I chop your kpňmo? All the water wey dey am, I dey drink am like juice, that one suppose don assure you say na you get me like this, forever. If you say make I jump, I go jump”

Peppe; e don do o, wetin happen? Tell me wetin dey make you bone like this, I never see your face like this before”

Matthew; e get one dream wey I get for my mama since I be small boy, that woman don too suffer, you no know all the insúlts wey she don chop for this life, because we dey poor, I wan carry am go vacation for Yankee, just for two weeks, she and my brother. I tell you the other time, you no even let me talk finish. See as I dey fly from one country to another one, but my mama just dey there dey old dey go, shey na when she reach 90 years, dey use walking stick, I go carry am go obodo oyibo for vacation? E no go make sense again”

Peppe; hahaha! Chai, this boy eeh, the way you love that your mama dey touch me, since day one, na so you just carry that woman for mouth, if say na like this my son love me, I no go dey shout too much. Shey na only this one be your problem abi you get another one?”

Matthew; na only this one, I no fit run am without your help and permission, I don even do international passport for them, e just remain make dem get visa, as me don already get visa because of you. If you do this one for me eeh, anything wey you want for this life, I go do am for you”

Peppe; hmmm! Anything?”

Matthew; yes, anything”

Peppe; okay na, if na so you talk am, I want make you begin chow the other hňle wey dey under my kpňmo”

Matthew; I no understand”

Peppe; wetin you no understand? Na you say you go do anything for me to help your mama and brother go vacation, I go even run their flight sef, una three like this, go use business class, I go pay for the hotel wey una go stay, from here, kon add pocket money join am. You sef know say I be billionaire, money na like sand to me, na small thing. So, wetin you talk?”

Omo, I weak as she talk am, but I no too reason am much, wetin she dey offer me pass wetin she say make I do, besides, na jakpa I wan carry my mama and brother jakpa, if na to chop númber 2, I go run am, clean mouth, e no go reach the nyamanyama wey Mama Uka give me chop, na to wash am wella before I eat, Peppe kukuma neat. I just hope say na only once I go do am sha…

Matthew; no lele, I go do am”

Peppe; oya na, make we start”

Matthew; na now? I think say na for next game, so that I go ready my mind wella”

Peppe; next game keh? When this game never end well for me, no make me laugh, abeg. I don gree say I go run everything, in-fact, by tomorrow, I go send person wey go meet them for house, to handle the application, then get date for interview, e no go reach 2 weeks”

Matthew; okay, no wahala. If na only thing wey I gatz do be this, for my mama and brother to enter abroad, I go do am”

Peppe; and who tell you say na the only thing? This one na to just ginger me to start the application for them tomorrow, the main one wey you go do na oath. E don reach time wey you go take oath, say you no go ever leave me. All these money wey I dey spend for you and your family head, you suppose give me assurance”…

Fear enter my body…

Matthew; haaah! Which kain assurance again you want make I give you? I don dey with you for years now, I never leave you, oath na strong thing o, that one fit kpai person”

Peppe; e no go kpai you, if you no break am. I know say you be good boy, but people dey change steady, ideas fit begin enter your head tomorrow, you go wan run me street. If you no wan do am, I no go force you, just comot your mama and brother vacation for your mind be that”

Matthew; I no get any bŕd thing for mind, just say the stories wey I dey hear about oath dey fear me, no be wetin I expect say I go ever do for this life”

Peppe; na so life be na, all the things wey me and you dey do so, shey you expect them before? Na as you dey grow, you dey experience things wey you no expect. This thing sef no suppose be anything, as far as you no carry anything bŕd plan for me”

Matthew; when you want make we run am?”

Peppe; e get one baba wey I get for ogbomosho, I go carry you go there next month, im no dey around for now, and me sef no too get chance this month”…

I reason am, next month still far, e remain 3 weeks before this month finish, I pray make visŕs don come out by then, God know say I no go take oath with Peppe or anybody for this life. Me wey my life just dey start, she just dey give me plenty reason wey dey ginger me to jakpa. Money and enjoyment dey this work wella, but the risks too plenty…

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *