Omo eeh, after that day, I reason this matter sote, my head wan nearly explňde, I no fit sleep. I know say once Peppe send person to collect my maale and brother passports, e fit no come out before that next month wey she say we go take oŕth. I been really like the woman o, as person wey don help my life wella, I get more than l5m for my account, na because of am, but I kon begin no like am again, she wan own me for life, me wey never reach 25 years, my life just dey start. I really gatz jakpa, but I no fit leave my family for Peppe house. Abi na to rent another house for them shaperly? Nna eeh, which kain wahala be this?

Early mormor like this, I don go meet my brother for im room to reason with am, na small boy im be, but he get sense wella, the boy too smart. Na me wake am from sleep, surprise catch am sef, as im see the way I dey waka up and down inside the room. He tell me to calm down, so that I go yarn am wetin dey sup. Na so I begin talk, everything wey Peppe tell me, I even talk how much she dey pay me every month, plus other side mula wey she dey sama me, whenever body too sweet am. He no talk anything, until yarns finish for my mouth, he kon tell me say im dey come, make im go pěss. I sidon dey wait am, until im finish from bathroom …

Matthew; guy, say something na, you just dey patrol up and down, fear dey catch me as I dey like this, I no know wetin I go do”

My brother; first thing wey you go do be say you go call am in the morning, tell am say me and maale say we no dey go anywhere”

Matthew; haaa! So na make I continue dey gbe?sh am forever ni? I say I wan jakpa, I no do again, and I no fit leave una for this house”

My brother; wait na, I never talk finish, your blood too dey hot. Me sef dey fear for you, she don carry the matter to another level, na to find your way sure pass, I know. See eeh, we go find country wey dey give visa easily for now, make we enter there with maale, go start life. Country wey no dey do interview before dem give visa, e no go reach 5 days like this, we don get am. If we stay there for like one year, we go from there do visa wey go carry me and maale enter yankee, since you don already get visa. If yankee hard to get, we find another place, as far as say me and you dey ready to hustle, we go rugged am. Make you sha know say life no go be like this forever, wey woman go dey load your account with mula, sun no dey touch you. Na after this jakpa, life go start for you, even this your babe, Oma, you go comot am for your mind for now, make we save your life first. Na person wey dey alive dey do love”…

I just dey nod, as im dey talk, I no follow am argue anything at all. Wetin I know wey I wan argue or talk kwanu? The kain fear wey dey my body no allow my mind rest. Na wetin Mama Uka tell me the last time wey she call me, I just dey remember. She tell me say I no know who Peppe be, say every good thing wey she do for me, she go collect am back, me just dey reason say na jealousy and vex dey make her talk am that day, I no know say she know wetin she dey talk. Peppe na her friend, dem soji each other.

When day break wella, my brother sidon for my front to give me ginger, as I call Peppe for phone, to tell am make she no send anybody again to collect my maale and brother passports, dem say dem no dey go anywhere. She change am for me, say agreement don be agreement, say even if dem no dey go again, she go still put visa for them, make dem keep am, say e no mean. As she dey talk more things, my brother kon gimme sign make I tell am say he wan follow her talk…

Matthew; my brother dey here with me sef, I don try convince am tire, but im say im no go release the passports and na him hold my maale own join”

Peppe; give am phone na”

When my brother collect phone, dem greet wella, like say nothing dey play, before the serious matter enter…

My brother; ma, I no know as I go take thank you for everything wey you dey do for us, na better person you be, I swear, God go too bless you”

Peppe; no problem, nna. Which one I dey hear so, say you no wan go vacation abroad?”

My brother; na the thing wey dey make me vex for Matthew be this, he go just dey make plans for me and maale, like say we no get choice, e no good na, im for tell us wetin dey im mind, if we like am, we go accept. The only thing wey dey my mind now, na school, except that abroad wey I dey go, na school I wan go enter, if e pass that one, I no dey go”

Peppe; You sure say you no go think this thing well so? Nobody dey reject this kain offer o, say you go vacation no mean say you no go enter school again. Abi you need small time to think am?”

My brother; okay, make we do am like this, I wan enter villa tomorrow, when I come back, I go make up my mind for wetin I want, I need to reason this thing wella, abeg”

Peppe; okay, e good like that. Oya, give Matthew the phone”…

Na so the travel matter take end, but Peppe still insist say we must go the baba place next month.
***********

After 1 week, my brother tell me say make he carry maale enter Awka go rent house for there, make me I book flight dey go yankee or UK, since I get visa, if I settle down there, get work, dem go do visa come meet me. The plan sweet me pass the first one, I give am better money, dem begin enter awka with flight the next tomorrow, my maale ask questions sha, but we give am lamba, and she believe am. When I sure say dem don reach Awka, and my brother friend wey dey there, don help them dey find house, I book my flight ozugbo, to enter America.

The day wey I suppose travel na night flight, na that day gan gan, Peppe sama me 2m wey she promise me, mula just dey increase for me. I no touch anything for the house, I just lock the gate, give the key to the woman wey dey sell something opposite the compound, I describe Peppe car give am, any time wey she see the car for front of the house, make she give am the car, I even find am better mula sef, wey make her happy.

When I dey airport, Peppe call me to tell me say the baba don come back, say we go enter there the next day, and na 3 days we go stay, say the óath dey take small time.
*****

E don reach 2 years now wey I jakpa, I don dey work, my brother and maale still dey try for visa, I know say dem go get am one day, I dey wait for them. Me and Oma still dey do boyfriend and girlfriend for video, she sef follow dey do visa, make she come meet me for yankee. I no regret anything wey happen for lagos, gbola really save me for life, no be only for lagos.

Babes don dey even rush me for here sef, but na coded I dey, I no wan comit, I hear say yankee girls no be like lagos babes, e no dey hard, dem go kpaě you, so I dey careful. Na only olňsho I dey pay, any time wey I wan collect, or I lock my door, go use my vŕseline do video call with Oma, life go soft!

The End

Watch out for the next story:

One thought on “Na Gbola dey save me for this Lagos Part 20 (Last Episode)”

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *